DATE YOUR FATHER

You break her heart she date your father
Our gehs these days don upgrade
Who get time to cheat with your friend
When I can be your step mother?

Bia, you why you dey look me like that?
You no see say I no be your class?
Go look for your class of babe
For us, na papa lolo we dey roll with.

I don't do cheap boys,
university strugglers need to find level
Dem no fit take care of me,
Na dia papa be honey!

Gone are the days of sugar daddy
Now our daddy is now baby
And the baby is now bestie
With our age mate.

Dem say dey wan rock life
Enjoyment wey dem no get since dem small
Now na their time for paparazzi
And now our mate be their chick.

So if you see person wey gree for you
Just do as your strength reach
No even try to break her heart
Your papa nakedness go trend for news.

Na fathers dem dey play with.

DATE YOUR FATHER.

A Poem.

©2019 Chines Zoe

Comments